Wednesday 21 October 2015

Experiment with Naija Langwej: Puwem

experiment' with the Naija Langwej.

A Don Dai!

As a de slip yestade nait
Mai hat jost de nak gbam-gbam
Na so so ''turn'' a de ''turn'' fo bed.
Bodi de pen mi and a no kari fayawud
Mai ai de pepe mi and a no kot onions
Wetin mai iye hia
Mai maut no fit tok
Di kasala we pesin don enta plenti wel-wel.

Mama Naija don lost im pikin egen!
Dem se dis wan no bi 'bomb blast'
Dem se dis wan no bi 'unknown gunmen'
Dem se dis wan no bi 'kidnapping'
Bot wetin man pikin sabi?
Enitin we mek pesin krai no gud lai lai.
Fia de kash mi no bi smol
Bodi de du mi laik se na ''malaria''
Si as Mama Naija sidon
De luk ol im pikin vanish
Opon ol di moni we shi get
Wetin kom bi mai hop?
''Poor'' man pikin laik mi?
A don dai!

No comments:

Post a Comment